Friday 16 May 2014

FA Cup Final in Pidgin English : Pressures on Arsenal




As Arsenal dem dey prepare to play dis Saturday FA Cup final agains Hull City, na enuff pressure go dey dia head make dem try plug de nine years wey dem still dey wey dem neva win cup.
Na for dis same FA Cup for 2005 wey dem beat Manchester United carri am dat year wey dem go still enta field on Saturday so.

Arsenal foma sabi midfielder Ray Parlour don even relate say If dem go just try win am, e fit open door for dem make jollication dey and plenti cup go begin dey come dia side.

Plenti all men bin dey even luk Wenger shoulda dey ask weda make de paale still remain for de work abi make hin waka since all de painment wey fans chop for all de years wey Arsenal no win cup.

Parlor sef come gree say fans fit vex dey halla but hin bilif say de club don mega since Wenger show for 1996 and if dem win for Wembley on Saturday, beta go begin dey shele.

"All de pressure dey on top Arsenal head now and to win am na im sure pass for Arsenal,"de foma England midfielder yarn as hin dey Singapore dey run some football tins for dia.

"To win de fes one na I hard pass, but if dem win on Saturday, door go begin open make plenti cup and titul begin dey show be dat."

Parlor come still relate say even if Arsenal no win am on Saturday, e no go gud make de sack Wenger becos dem go nid make tins setul come dey steady and come show hand for wetin dey hapun for Spurs as dem just dey change manager like woman wey dey change wrappa

"I know say supotas dem go dey para anyhow say Arsenal don tey witout cup but for my church mind, since me finish my career na eight times we don chop numba four for tabul, dat one no gud at all.

"Me wan tok say I win dis one and dat one, de playas now sef no different. No be kulele matter, na to win titul sure pass.

"Arsenal dem must to spend beta money find beta playas take add for de ones wey don sign join for ground, all we young playas don sign, see Koscielny, Ramsey and Cazorla sef, na dose ones wey supose arrange no be de ones wey dey find pepper wey dem go use retire.

No comments:

Post a Comment