Thursday 15 May 2014

PIDGIN ENGLISH TIME: Super Eagles coach Keshi salutes players





Supa Eagus coachi Stephen Keshi don kommot hin cap dey salute all de Eagus wey no fit make am enta de 30 man army wey go enta camp for de world cup.

Keshi who helep Naija win de 2013 Nations cup salute Leon Balogun, John Ogu, IK Uche and Brown Ideye wey no go follow am enta Brazil for de world cup.

Wetin kon make Oga Keshi dey salute dem be say all of dem no vex sham sham sake of say dia name no dey de list and naso dem promise to support de Eagus for de world cup.

“Unna all know say I no fit carry everybody go Brazil for de world cup and no be say all de boys wey I drop no sabi, but I no juss fit carry all of dem enta plane.

“My belle dey sweet me as all my playas understand wetin I do, and I wan troway salute to all of dem wey no fit make am,”.

Meanwilly, na June 2 na hin Oga Keshi go do hin final naming ceremony of de 23 Eagus wey dey go Brazil, and de man tok say no body get automatic shirt.

“I juss wan make all Naija fans dey support us, and as de matta be now, no body among all my playas get automatic shirt and de play play games wey we go play go also determine who go follow me enta Brazil,” naso Oga Keshi tok

Supa Eagus dey for Group F and dem go jam Iran, Bosnia and Argentina for de world cup wey go start ness month.

No comments:

Post a Comment